Nigerian School Resumption Update: How To Keep Your Pikin Safe As Schools Dey Reopen Afta Covid-19 Lockdown

Nigerian School Resumption Update: How To Keep Your Pikin Safe As Schools Dey Reopen Afta Covid-19 Lockdown



4 years ago

~8.4 mins read

Advertisement

Some states for Nigeria don join di world to okay school reopening for September afta goment bin close down all schools for di kontri since March sake of di coronavirus pandemic.

Most state goments okay make primary, secondary and tertiary institutions resume, 21 September, 2020.

As dis one dey happun, United Nations Children' Fund (UNICEF) don give some tips on how parents fit help dia children overcome any fears or concerns dem fit get about school resumption. UNICEF also help answer some questions wey fit dey bother parents mind as schools reopen.

  • My child dey fear to go back school. How I fit help relax im mind?
  • Follow your pikin tok, hear why him or her dey fear and make dem understand say e dey normal to worry as dem enta classroom for a long time.

    Children fit no wan go back to school, especially di ones wey don dey learn from house.

    Admin Sponsored

    Make money posting ads on your blog

    Generate passive income with your blog, website or social media. Join Adsterra

    Cinque Terre
    Dem also fit dey tink say e go dey difficult for dem to maintain physical distance from dia friends and teachers for school. Encourage dem to find oda ways dem fit connect wit dia friends and dem no go too near each oda.

    Papa and pikin

    Tell dem about di safety measures wey dey to keep students and teachers healthy and remind dem say make dem dey wash dia hands wit soap and water all di time. If dem wan cough or sneeze, make dem do am inside dia elbow.

    Remind dem about di good things wey dey if dem go school, dem go fit see dia friends and teachers and continue to dey learn new things.

  • E get anything I need sabi as my child dey go back school?
  • School children

    Concerns dey say stigmatization and bullying fit increase as children go back school sake of di wrong information dem don hear around Covid-19.

    Advertisement

    You need explain to dem say di virus no sabi who anybody be, where dey come from or di language dem dey speak. If anybody yab or bully dem for school, make dem report to adult wey dem trust. Tell your pikin say everybody deserves to be safe for school and online.

  • How I fit encourage my child to follow precautions (such as regular hand washing, physical distancing, etc.) for school wey no go worry her?
  • Teach child how to wash hand regularly

    One of di best ways to keep children safe from Covid-19 and other yamayama diseases na to encourage regular hand washing. No be wetin need serious tok, you fit use am sing, dance, do wetin go make am fun to learn. Make sure to teach dem how even though dem no fit see germs wit dia eyes, e always dey. Wen children understand why dem need to wash dia hands, dem go continue to wash am.

  • My child school say make children dey wear protective clothing, and di thing dey fear my pikin, Wetin I fit tell her?
  • Follow your child tok gently say you understand how she dey feel about coronavirus but she need wear protective clothes to keep her and those around her safe.

    .

    Was my post useful? Support me to keep creating useful content

    Disclaimer If this post is your copyrighted property, please message this user or email us your request at team@pejoweb.com with a link to this post




    10 likes
     

    Advertisement

    ";

    Advertisement